Sunday, September 30, 2012

Jatau Hadiza Jessica Aramide- I LOVE MAI COUNTRY

Na only for Nigeria you fit win Aeroplane by loading #200 MTN Recharge Card.=D

Very soon Etisalat go say recharge #200 and win a big ship. =D

Then Airtel go com follow sey, recharge #100 an win benin republic. =D

Glo, go jus kuku say... Recharge 500 and win Nigeria bcos there colour na Green =D

Na only for Nigeria you go see fish inside "MEATPIE" =D

Na only for nigeria we dey count money after we withdraw am from ATM because we no even trust ATM machines.=D

Na only for Nigeria PHCN dey sey:
Win a brand new GENERATOR if you pay your light bill (wat a piti)=D

Na only for Naija people dey horn for traffic light make e quick change frum Red to Green.:)

Na only for Nigeria Pharmacy dey sell Coke, Recharge Card, Chin chin, Puff puff, Ogogoro and beer.=D

Wetin you u no see for Naija, you no fit see am anywhere in d world... Trust me.

Abeg na joke o, no take am personal O =))

I love Naija!....


Sent from my BlackBerry® Smartphone, from Etisalat. Enjoy high speed internet service with Etisalat easy net, available at all our experience centres

0 comments:

Post a Comment

 

©2009 BJB-007.com | by TNB